Illustration of a Photojournalist, Frontline Rescuer, and Aid Worker in a war zone

War Toys: Evac Ops™ na table game wey all de player dem nid to work togeda, di three players na: de Main Savior, War Newsperson, and de Supporter. Una must work together and use correct talent to save ordinary kontri person for inside dangerous war zone. Work fast before time, resources, or luck finish!

  • Fronline Rescuers

    Di Main Savior dey really try dey save plenti kontri people for area wey war dey well-well. Dem bin don train dem well-well since for how dem fit save people from all kain bomb Aeroplane wey dem dey use trowey bomb, some Machine Gun, or trowey from armour car.

  • Combat Photojournalists

    Dis War Newsperson wey dey use plenti picture and video show everybodi for TV or internet all de bad-bad tins wey war dey do people everyday inside de kontri wey e dey hapun. Na all dis foto wey go make many people to see wit wetin dey happun so dat dem go begin to dey send money, food, dress, or oda tins wey go ginger Di Main Saviour and Supporter dem to work more to help de people wey dey suffer for war.

  • Aid Workers

    Supporter dey help di kontri people wey de war wahala dey suffer to arrange beta place dem go fit dey stay. Dis Supporter dey folo work wit big-big join bodi people plus group dem wey dey help people wey war wahala dey suffer. Dia work dey include dey treat people wey sick or wey don wound, to folo build simple-simple house wey go dey safe for everybodi wey run escape from de, to dey share food, cloth, shoe and oda beta-beta tin dem to evrybodi for dia.

Illustration of player sharing a mobile device to play a board game

Evac Ops sweet pass when una sidon around di game table, and e fit play in different ways:

  1. Una fit share mobile device between players and make di Evac Ops app guide una through each turn.

  2. Una fit follow di instructions below to play with di game pieces wey come with some play sets.

  3. Or una fit download and print una own game pieces.

Prototype of War Toys: Evac Ops board game

Evac Ops Toy Figures

Khaled

Mouna

Dominique

Ashok

Asmaa

Byron

Ron

Vero

David

Chris

Nicole

Dickey

Most game sets include: 2x Di Main Saviour, 2x Supporter, and 2x War Photogragher dem (random)

Evac Ops™ na from War Toys® wey bi nonprofit organization wit di support of:

Made by:
Believe-Fly Toys Co., Ltd. Shantou, China
Wholesale inquires (MOQ 3000 pcs):
market@beflytoys.com